Manchester united pour sand-sand for Man City Garri

Wetin be dis? Na the question wey Guardiola ask himself afta him take 3 kondo ontop 2 wey him wan take yamayama Mourinho.
Guardiola slap Mourinho 2goals wey don make am cry, but the Adaripon color head boy Paul Pogba com carry the ball slap Guardiola back , take 'am!!! your father dere! na so him give am 2back . Chris come carry hand join Pogba slap Guardiola say ''you think say as Liverpool slap you we no go do our own?
Na so the mata be ooo .Mourinho don use water wash the slap comot for him face but dem Man U still dey 2nd position wit 13points behind Man City wey dey 84points.

Comments

Popular posts from this blog

Celebrate - Our Father Venerable Superior Evangelist G.O Jerry

Happy Birthday - Celebrating Anoop Satyan